Run (feat. Gonzalo BlaQ)

Chukwuebuka Ugwueze, Roland Ugwueze

Oga popo don dey come o
See them with their gun
Them dey come them dey come
Oga better make you run
Oboy no dey look your back o
Abobi just dey run
Just dey run just dey run
Fast before them shoot their gun
Me I dey my lane o I just light my blunt
My Nigga dey chill
With the codeine for hin cup
Popo dey around o see them for the back
All their eyes don red
Them dey look for who to knack
Them no go look your face o
If you talk na slap
Everything you talk
Omo none of them be cap
Kai Kai dey their vein o
Omo them don muzz
But them wan stop boys
For the muzz wey we dey muzz
Me I dey push the pedal to the floor
Be like sey we dey for class
The way we dey zoom the car
Four of us for the car
Them go knack us blue and black
Me wey get kush for hand
This one wey lyn dey hin cup
One man tongue don turn blue
This one sef don come pass out
If them catch us chai I swear
Them go fuck us up for here
No be sey we dey fear
We just wan lap girls for there
We tell them sey we dey
Carry things dey come their way
Them dey wait make we lap
So that we go fit to trap
After high we go chow
Then we go fit come dey knack
But the popo dey my back
Them dey move like them dey mad
Them dey check if we go
Brake but omo boys dey ment
No just do me make I vex
Bros I no be criminal
I don't like
What the popo do to make me minimal
Black on black they make you park
They just need that rack on rack
Officer I no too get I dey work I wan get
Pimpini they just want your tinkili
This is just the beginning
This na the ghetto symphony
Run run
Run run aboy make them no catch you
Cuz if men them catch you
Soso lap them go dey lap you
If you no get money I'm very very sorry
Your name go turn Clinton
The way them go dey bill you
If you no get doings I'm very very sorry
Oga popo don dey come o
See them with their gun
Them dey come them dey come
Oga better make you run
Oboy no dey look your back o
Abobi just dey run
Just dey run just dey run
Fast before them shoot their gun
Oga popo don dey come o
See them with their gun
Them dey come them dey come
Oga better make you run
Oboy no dey look your back o
Abobi just dey run
Just dey run just dey run
Fast before them shoot their gun
Shey you know sey me I no dey here
When the popo come one time na japa o
Shey you know sey me I no dey here
When the popo come one time na japa
Oya run run
Run run run run
Run
Abobi run run run run
Run
Run run run run
Run
Abobi run run run run

Músicas mais populares de Roland

Outros artistas de House music