Only me

Roland Ugwueze

No be only me Waka come
God dey my back hin dey tell me move on
I get patience and I get good luck
Make them talk if na talk them wan talk
Uh
If na only me waka come
Then e go be bad decision
But God dey my back hin dey tell me move on
I get patience and I get good luck
Every smoker must get lighter
Every prisoner must know jailer
For my country dem dey suffer
Some people them no see supper
Poverty for the land
People dey die
Plenty dey sup but you keep me alive
You put me on a mission
Now I dey television
This na real no be fiction
It really wasn't necessary
The blessings you dey pack dey give me
Extraordinary
Enemies they've been acting friendly
I know sey all of them they envy
The way that you bless me
No be only me Waka come
God dey my back hin dey tell me move on
I get patience and I get good luck
Make them talk if na talk them wan talk
Uh
If na only me waka come
Then e go be bad decision
But God dey my back hin dey tell me move on
I get patience and I get good luck

Músicas mais populares de Roland

Outros artistas de House music