Situation Room [Album]

Erhiga Agariubie Agariubie

Abeg
Paper paper boy
2019 mhen how e be
Brenny Jones ti de o
I wan give you story now from the situation room
King paper
How e take happen for area real real
Just now just now here e never too tey

I be ghetto boy and I like to chop money chop money there
Iji ego I like too much money
I still like dem type Adeleke money (Adeleke money)
Plus Otedola all that kind money (Biggie biggie money)

Oh kpakam
If I make this money kpakam
I go buy full Lekki kpakam
If I make this money kpakam
I go buy Ferrari kpakam
If I make this money kpakam eh ehn guy how far
I go flex my mama kpakam that matter wey I say I wan clear you
If I make this money kpakam eh ehn na this so ma just clear you now for this yarn
I go spend this money

E get one matter when play
You know my guy Sparko
That my tall black guy when dey stay airport road
No be small matter happen for area o
As I dey follow you talk dey yarn four person don go
Dem say dem get one transaction wen be say dem do
Abi na one million Dollars when dem say somebody chew
The matter be say the guy dey work client tey
Na im make dem run money for the client make she pay
When money finish dem wan come die the money
For this small Warri dem wan guy the smallie
Some kind brah for the area dem be deadly
No need to give dem money buy two Benelyne
Dem don enter motor dey go find the pick up
Two kala cut to size all of them kit up
One dey hurry so tey e cock him gun down
Enter speed breaker he mistakenly gun him own man for front seater
Driver don confuse
Don turn him hand no dey face road
The kind trailer when jam dem comot
Na those kind trailer when when dey carry load

Oh kpakam
If I make this money kpakam
I go buy full Lekki kpakam
If I make this money kpakam
I go buy Ferrari kpakam
If I make this money kpakam
I go flex my mama kpakam
If I make this money kpakam
I go spend this money

So I pray I pray gan gan
I pray I pray
So one day one day one day
Hustle go pay e go pay I pray
Oluwa I dey pray

For this life ehn no be who get money now get money
You no know all those bank gate men
You know how much dem get when them dey their twenties
You go hustle after you say your morning amen
Four of them laugh them dey drive dey go
Dey reason life some of them don spark their kpo
Dey think wetin dem go do once the money show
One say music the rest say na ashawo
Or go downtown buy all their men ibo
You no fit blame them na the only thing when them know
Na there one say po po fit dey around
So e cock e cock e cock e kala down
Be like say the nose face the guy for front sit
See police for front the guy halla shit oh shit
Him no see the speed breaker him jam am kpoo
Accidental discharge he own man kpoof

Before now him say
If he make this money kpakam
Him go buy Bugatti kpakam
Him go take the money kpakam
Buy everything kpakam
Before him hear gbagaun
The man don go
Where him take gbagam
Him no believe him Bible

So I pray I pray gan gan na real matter
I pray I pray confirm matter legit matter
So one day one day one day omo na prayer matter
Hustle go pay e go pay abeg
I pray spiritual
Oluwa I dey pray

We dey pray Oluwa
Untimely death no be our portion
Give us E T C money oh
Money wey no get finish fete rise fetera type of money
Na so e just be mhen
I fit carry you reach the water
But na for you to learn how to swim
Motivate yourself pro pro pro pro

Curiosidades sobre a música Situation Room [Album] de Erigga

De quem é a composição da música “Situation Room [Album]” de Erigga?
A música “Situation Room [Album]” de Erigga foi composta por Erhiga Agariubie Agariubie.

Músicas mais populares de Erigga

Outros artistas de Afrobeats